01/09/2024
Types of C of O in Nigeria
In Nigeria we have 6 types of C of O
And the best among them is the Family C of O.
This one na the only C of O wey no dey expire
Na for life, till thy Kingdom come
And na only Omonile wey their family get levels dey get this kind of C of O, because na them gangan be the Real Original Land owner and seller.
Even all the Real £state C0mpanies wey you dey see so ehn, Na Omonile Hand dem sef dey take buy Land.
This type of Land dey appreciate in value daily with the speed of Light.
Oga congratulations once again.
Mek i touch light other types of C of O small
2. Residential C of O also know as Individual C of O:-
You get this one if you buy land for whrw govt allocate say make ppu build house and the C of O is only valid for 99yrs....after 99yrs e go expire....the land go become govt own again until u renew am...and if dem reject your renewal request....sope Otilo
3. Agricultural C of O :- if you go buy land for where govt talk say make we dey do farming, na Agricultural C of O dem go give you .....so as you build house try do small farming on top make u take dey safe....and this one is valid for only 28yrs...after 28yrs apply for renew and if them reject your renewal application....Sope Otilo... Landlord don become tenant be tbat o 😂😂😂
4. Industrial C of O :- this na area where govt leave to build industries
5. Govt Allocation:- this one na wen govt use their own hand and korokoro eyes dash you Land
6. Excision:- if you buy Land for village, Na Excision dem go give you.
No go dey find C of O for village oooo.
Try dey do due diligence before you buy Land, make you no go buy Land for where dem allocate to bury ppu oooo
Pls don't keep this information to yourself alone
Lets grow in learning together.
Spread it